How una Dey? Thank You All For All Your Entries. Personally, Me i Enjoy am.....But Sorry Na Maxwell Win The $100 , Abeg Come Pick Up Your Money Ooo(B4 I Change My Mind) lool #Bless
Tha Suspect
In Chioma's Mind. They say the human mind is a story that can never be completely told. Well my mind is a story just beginning. I just want you to take my hand as i lead you through the enchanting and exhilirating of Chioma's mind... *N.B: THIS IS SEMI-FICTITIOUS BLOG, ANY RELATIONS TO REAL PEOPLE, PLACES,TIME AND EVENTS ARE BLOWN WAY OUT OF PROPORTION (follow me on twitter- @itzmrsbosslady )
Thursday, 16 February 2012
Tuesday, 14 February 2012
HOW VALENTINE DEY AFFECT OUR ECONOMY by Emmanuel Dike
Valentine! Valentine!! Valentine!!! Omo I taya o, even small pikin sabi wetin the word mean sef, if e dan reach times like this, people go begin worry unnecessarily. Haba, e no pure. Me no dey against the Valentine Movement o(afta all I no get chik), but if them say make I tok, e dey affect plenty things, una go hear all, and even as e take affect you join.
For my point number one, e dey cause DIVERSION OF ATTENTION FROM INVESTMENT! You go wan dey reason how, make your blood no rush, I mustu tok am. Adult wey suppose to use I'm money buy house or invest am put for hot shares go use I'm money take buy big gift for gal call am valentine, I'm. Go leave money wey suppose to yield pikin for bizness use buy bb porsche for gal, Ogah, if na Ў☺ΰ be economy, u no. Go vex?
Number two point, na women dey cause this one, dem dey turn sum men to thief all in the name of ♡̷̴̬̩̃̊ of one day, make I give you instance. When I bin dey SS3, I thief my papa money to use buy gift for gal( ask me where the gal dey today), una dey see? Now, compare me with person wey dey in charge of very big money, wey dey work for places where money no dey wear clothe. After, them go say money dey miss, who cari am, every body turn to deaf and dumb but tomorrow, gal wey never pass jamb go carry 2 BB phones with one I-pad dey waka.
Una dey see my point shey, oya check now wey gals wey suppose enter skul turn doctor tomorrow or lawyer sef go collect 'something' from her guy, give 'something' back, then after 9months, another 'something'. Go cumot(no ask me from where)that is if them no kumot am sef. Apart from say them dey increase population, them dey jonze their future.
Finally,we dey tok say subsidy 'do' us na I'm valentine wan cum 'rape' some people finish, e don be 4 them na! How flower( na I'm cheap pass) wey be N150 before subsidy o turn N1000 all because of velentine, e no fair na, aw poor people wan take celebrate? Mr Biggs them. Go wan increase sharwama price, maybe, Mama Sunday.go add money for her food kwa, she gats to meet up na.
Ah. Go end by saying no b everything wey glitter b gold, try. Go church. Go do yhur valentine, e no suppose make economy shake badly, offering suppose increase, afterall na God be ♡̷̴̬̩̃̊,happy valentine people o, spread the ♡̷̴̬̩̃̊ and not the virus, spreadnot the conji and not the legs!!!!

HOW VALENTINE DEY AFFECT OUR ECONOMY by Tobenna Okoye
Valentine day na flexing day. As we dey talk flex no bi just straf. Bcos dat day na 50/50. The guy chop from d babe body and the babe go chop from the guy pocket. Na d babe aspect we dey talk about bcos na their own dey affect economy wella for that Val's day.
As February dey enter wetin dey people mind(people wey jasi) na how valentine go bi? The date no dey alrite for most people bcos na almost middle of d month wen pepper don almost disappear finish, boys go dey don dey broke. Bcos the people wey dey on salary yapa. The people wey dey make money every week no plenty for naija. So na those ones wey dey on salary dey give economy wahala. Na like this the tin dey happen. After January salary for ur mind u go try save for Feb14 so u and ur chick go flex wella. But before that time, tinz go just dey come wey go dey finish ur money. As we dey enter new month we go dey try plan on how we go spend small small. But the tin bi say e no possible. Money go still dey burn wella. If say u get like 400,000 as January salary, u go don use like 5,500 for credit before Feb14, your youger brother or sister wey u fit dey train for skul go come again collect allowance. U fit release like 10,000. You gats dey chop sef, comot 20,000. Nepa go still dey dull so money for fuel for ur gen go still dey, maybe like 30,000. No forget say all the money wey don burn na before Feb14 o! Your pocket for don leak finish. But at least u still hold small change for val. Wetin remain na how to celebrate val.
The people wey dey do Val tinz sef no dey try for boiz. Na dat time ordinary plate of rice go increase like 200%. If say u dey chop one plate for 1000. The tin go fly go 3500. And u gats buy for two people which mean say u go drop 7tawa! And dat na if your chick sabi wetin u dey earn or two of una don dey understand una self wella. But if na babe u meet for club d previous weekend and u wan straf am dat Valentine night, u fit drop like close to 30bar for Mr. Biggs(because una dey chop wetin una go soon shit comot, mscheeew). Okay una chop finish wetin con remain na gift. Whether two of una understand una sef wella or u wan straf the babe, u go still like show urself, u go like impress the babe. If u fit go pick one of those mumu Valentine gift packs wey dem dey show for TV wey be like 100jeez.
After everytin Feb15 d guy go don broke finish. From that 400k wetin remain fit bi like 20,000. The next tin na to dey borrow money from bank. No forget say na guys all over naija dey suffer this kain tin. So banks go dey borrow boys money the tin go dey wreck our GDP and the GDP na d major part of the economy. Why this tins dey happen like this. Na becos of valentine oooo!!
HOW VALENTINE DEY AFFECT OUR ECONOMY by Jedidiah Ikoba
Valentine na for lovers. Na for everywhere for d world o but naija we carry valentine 4 head well o.Secondary school students o,even primary school dis days don dey get val.As for university nor go there o. Dem dey finish work for this valentine tory. Na girls dey enjoy dat day pass ni. Na so we guys o, aristos or maga(the bigger d pot belle d more d money) go dey buy fine gifts 4 their girl friends, d kind one wey dem neva buy give their malle or wife once sef. Oyinbo pipo own u fit jus buy one flower or card for your chick but 4 naija,try am first! D babe go tear d card 4 your present or stone u wit your yeye flower. She go ask u if dem dey chop am? So na rule o. U must buy expensive gift for your babe and una must to go out o. So tay sum guys for uni those days wey dey do 0-1-0 eatin formula go buy beta shoe or phone 4 their chikito come carry her go fastfood wen him neva enta at all before. Some go even use their skool fees do am o.
Evn married couples join for the matter o.Afteralls dem be lovers too! Na so expensive gifts go dey flow. But my broda wetin dey pain me be say after guys don buy expensive gifts giv these girls na cheap tins like boxers, singlet,cheap watch naim dem go buy giv d guys. Dat na wayo na, correct akpaco d babes dem be.
Now how dis one take affect our economy sef. My broda me I nor see o. E nor dey affect our economy one kobo! Forget say guys dem dey buy expensive gifts and go outings wit the babes dat day. Instead na oyinbo economy we dey develop. Almost all d gifts wen we dey buy dat day na obodo oyibo dem dey import dem come,even up to card sef becos na only to consume we sabi. So in the end our economy siddon for d same bottom wey e dey. Instead sef we dey lose money & our economy dey die go.
Sum guys dey go thief or do yahoo or thief from gofment(those wey be politicians and workers) so dat dem go fit meet up,so corruption dey increase. Girls sef dey get belle anyhow,HIV dey spread. All dis tins too dey kill our economy bcos the youth na dem be the ogbonge pilotay for d economy steerin and 419 wit him bros corruption dey kpai our economy. Fear nor go let oyinbo come here bcos dem go open oFfice for him head.
Last last,love na evryday tin no be only jus for valentine day. If you love the boo or sisi, dey show the love everyday nor be only for valentine. Shikina!

HOW VALENTINE DEY AFFECT OUR ECONOMY by Maxwell Maiye
Nigeria na country wey be sey we dey rely so much on things wey we dey import come from obodo oyinbo. So tey even we own oil wey we dey produce naturally we still dey import am come as kerosene, petrol and diesel because sey our refineries to take wash am no dey work.
Meanwhile no be only products we dey import. Wetin oyinbo man call technology sef follow join, plus sub cultures and idealogies too, that one mean sey the kind pattern wey person dey take reason.
Na im be say this Valentine so wey people carry put for head na import we import am oh, because no be we get am, no be we start am, no be we idea.
But you sef go gree say as the world don take be so, everything na everybody own. Wetin oyinbo man call globalization and cultural assimilation don happen wey be sey people they practise things wey no be their own originally. So I no fit beef people wey carry the Valentine for their head. As they like am make dem dey celebrate am dey go. If person buy me gift I go collect but I no dey buy give person oh.
So now, on to the koko of the matter wey be how valentine take dey affect our economy. I don first yarn say na so so import we dey import. If you waka from your hood reach my side, you go see more business wey be sey na to buy come put for shop sell be their own. Industries, both the one wey dem call mega and the one wey dem call cottage industries, scarce for we country die!
As he come be like that, this Valentine period so wey people go dey buy one thing or the other foe their wife, husband, boyfriend, girlfriend, side chick, bed mate, secret admirers, sales of gift items and Valentine related products go dey on the increase. Already, boutiques don dey sample red cloths come outside since the beginning of the month as he be sey na red be the colour of Valentine.
Trips to Dubai and all the places wey people dey buy things come from go increase as well.
For the entertainment industry, Artistes and Comedians as well as people wey dey feed off dem, managers, dancers, back up singers, show promoters, go still see beta change collect take increase their bank account because shows go dey make boys for fit take their babes out on trips.
People wey dey the hospitality business, hotels, eateries, restaurants(no be mama put oh or iya basira), guest houses, go get increased patronage during Valentine.
Sales of condoms too go follow increase.
We dey data shy for we country so statistics no too dey available to take drive home my point say people the spend wella during this period. Valentine just be like christmas for some people oh.
The economy na issue of money. During Valentine, people dey spend wella. The problem be say e no dey bring overall growth or development for the economy, na just say e dey release cash from people pocket into the system. I don talk finish. Gbam

TO BE LOVED AND LOVED IN RETURN
Happy St. Valentine's Day People!!
I woke up pretty excited today. And I was even more excited when my boss showed up at the office with a huge Valentine cake for the team to share. So the day is looking good...
I recall Valentine's day some years ago when i was in the TV production business. We decided to put together a live show on the TV station hosted by popular celebrities from the then MBGN Munachi Abii to ace actor Zack Orji where viewers could call in and give their shout-outs. The show was a huge success and the following year, viewers were requesting a repeat broadcast.
In preparation for the show that year, we had to do extensive research into the origin of St. Valentine's day celebration. To our surprise the details of the origin of the celebration were a bit hazy. Some stories say St. Valentine was a prisoner who fell in love with a King's daughter while others say he was a Catholic priest who cared for the needy in the society. In a feature story as part of the live show, the script was concluded on the note that whatever the true origin might be, there was one thing they all had in common; Pure, selfless love.
I have always been a believer in the power of love. In my opinion, it can break barriers and mend relationships in a way that can be seen as simply amazing. So, as we go about celebrating St. Valentine's day in the ways we know best, let us remember to show some act of selfess love.
xoxo
Chioma

Subscribe to:
Posts (Atom)