Tuesday, 14 February 2012

HOW VALENTINE DEY AFFECT OUR ECONOMY by Maxwell Maiye

Nigeria na country wey be sey we dey rely so much on things wey we dey import come from obodo oyinbo. So tey even we own oil wey we dey produce naturally we still dey import am come as kerosene, petrol and diesel because sey our refineries to take wash am no dey work.
Meanwhile no be only products we dey import. Wetin oyinbo man call technology sef follow join, plus sub cultures and idealogies too, that one mean sey the kind pattern wey person dey take reason.
Na im be say this Valentine so wey people carry put for head na import we import am oh, because no be we get am, no be we start am, no be we idea.
But you sef go gree say as the world don take be so, everything na  everybody own. Wetin oyinbo man call globalization and cultural assimilation don happen wey be sey people they practise things wey no be their own originally. So I no fit beef people wey carry the Valentine for their head. As they like am make dem dey celebrate am dey go. If person buy me gift I go collect but I no dey buy give person oh.
So now, on to the koko of the matter wey be how valentine take dey affect our economy. I don first yarn say na so so import we dey import. If you waka from your hood reach my side, you go see more business wey be sey na to buy come put for shop sell be their own. Industries, both the one wey dem call mega and the one wey dem call cottage industries, scarce for we country die!
As he come be like that, this Valentine period so wey people go dey buy one thing or the other foe their wife, husband, boyfriend, girlfriend, side chick, bed mate, secret admirers, sales of gift items and Valentine related products go dey on the increase. Already, boutiques don dey sample red cloths come outside since the beginning of the month as he be sey na red be the colour of Valentine.
Trips to Dubai and all the places wey people dey buy things come from go increase as well.
For the entertainment industry, Artistes and Comedians as well as people wey dey feed off dem, managers, dancers, back up singers, show promoters, go still see beta change collect take increase their bank account because shows go dey make boys for fit take their babes out on trips.
People wey dey the hospitality business, hotels, eateries, restaurants(no be mama put oh or iya basira), guest houses, go get increased patronage during Valentine.
Sales of condoms too go follow increase.
We dey data shy for we country so statistics no too dey available to take drive home my point say people the spend wella during this period. Valentine just be like christmas for some people oh.
The economy na issue of money. During Valentine, people dey spend wella. The problem be say e no dey bring overall growth or development for the economy, na just say e dey release cash from people pocket into the system. I don talk finish. Gbam

No comments:

Post a Comment