Tuesday, 14 February 2012

HOW VALENTINE DEY AFFECT OUR ECONOMY by Emmanuel Dike

Valentine! Valentine!! Valentine!!! Omo I taya o, even small pikin sabi wetin the word mean sef, if e dan reach times like this, people go begin worry unnecessarily. Haba, e no pure. Me no dey against the Valentine Movement o(afta all I no get chik), but if them say make I tok, e dey affect plenty things, una go hear all, and even as e take affect you join.
  For my point number one, e dey cause DIVERSION OF ATTENTION FROM INVESTMENT! You go  wan dey reason how, make your blood no rush, I mustu tok am. Adult wey suppose to use I'm money buy house or invest am put for hot shares go  use I'm money take buy big gift for gal call am valentine, I'm. Go leave money wey suppose to yield pikin for bizness use buy bb porsche for gal, Ogah, if na Ў☺ΰ be economy, u no. Go vex?
    Number two point, na women dey cause this one, dem dey turn sum men to thief all in the name of ♡̷̴̬̩̃̊​ of one day, make I give you instance. When I bin dey SS3, I thief my papa money to use buy gift for gal( ask me where the gal dey today), una dey see? Now, compare me with person wey dey in charge of very big money, wey dey work for places where money no dey wear clothe. After, them go say money dey miss, who cari am, every body turn to deaf and dumb but tomorrow, gal wey never pass jamb go carry 2 BB phones with one I-pad dey waka.
    Una dey see my point shey, oya check now wey gals wey suppose  enter skul turn doctor tomorrow or lawyer sef  go collect 'something' from her guy, give 'something' back, then after 9months, another 'something'. Go cumot(no ask me from where)that is if them no kumot am sef. Apart from say them dey increase population, them dey jonze their future.


    Finally,we dey tok say subsidy 'do' us na I'm valentine wan cum 'rape' some people finish, e don be 4 them na! How flower( na I'm cheap pass) wey be N150 before subsidy o turn N1000 all because of velentine, e no fair na, aw poor people wan take celebrate? Mr Biggs them. Go wan increase sharwama price, maybe, Mama Sunday.go add money for her food kwa, she gats to meet up na.
  Ah. Go  end by saying no b everything wey glitter b gold, try. Go  church.  Go  do yhur valentine, e no suppose make economy shake badly, offering suppose increase, afterall na God be ♡̷̴̬̩̃̊​,happy valentine people o, spread the ♡̷̴̬̩̃̊​ and not the virus, spreadnot the conji and not the legs!!!!

2 comments:

  1. Emma...ù Ƌ̲яε̲̣̣̣̥  best...al U̶̲̥̅̊я tatafo na true talk ßε D̶̲̥̅̊α̲̅†̥ ...even say ɪ̣̝̇ ßε woman wey D̶̲̥̅̊ε̲̣̣̣̥y 4  receivin' angle...tHumpz up!

    ReplyDelete
  2. lorl,dis peice addressd a lot of issues,nice one!

    ReplyDelete