Tuesday, 14 February 2012

HOW VALENTINE DEY AFFECT OUR ECONOMY by Tobenna Okoye

Valentine day na flexing day. As we dey talk flex no bi just straf. Bcos dat day na 50/50. The guy chop from d babe body and the babe go chop from the guy pocket. Na d babe aspect we dey talk about bcos na their own dey affect economy wella for that Val's day.
As February dey enter wetin dey people mind(people wey jasi) na how valentine go bi? The date no dey alrite for most people bcos na almost middle of d month wen pepper don almost disappear finish, boys go dey don dey broke. Bcos the people wey dey on  salary yapa. The people wey dey make money every week no plenty for naija. So na those ones wey dey on salary dey give economy wahala. Na like this the tin dey happen. After January salary for ur mind u go try save for Feb14 so u and ur chick go flex wella. But before that time, tinz go just dey come wey go dey finish ur money. As we dey enter new month we go dey try plan on how we go spend small small. But the tin bi say e no possible. Money go still dey burn wella. If say u get like 400,000 as January salary, u go don use like 5,500 for credit before Feb14, your youger brother or sister wey u fit dey train for skul go come again collect allowance. U fit release like 10,000. You gats dey chop sef, comot 20,000. Nepa go still dey dull so money for fuel for ur gen go still dey, maybe like 30,000. No forget say all the money wey don burn na before Feb14 o! Your pocket for don leak finish. But at least u still hold small change for val. Wetin remain na how to celebrate val.
The people wey dey do Val tinz sef no dey try for boiz. Na dat time ordinary plate of rice go increase like 200%. If say u dey chop one plate for 1000. The tin go fly go 3500. And u gats buy for two people which mean say u go drop 7tawa! And dat na if your chick sabi wetin u dey earn or two of una don dey understand una self wella. But if na babe u meet for club d previous weekend and u wan straf am dat Valentine night, u fit drop like close to 30bar for Mr. Biggs(because una dey chop wetin una go soon shit comot, mscheeew). Okay una chop finish wetin con remain na gift. Whether two of una understand una sef wella or u wan straf the babe, u go still like show urself, u go like impress the babe. If u fit go pick one of those mumu Valentine gift packs wey dem dey show for TV wey be like 100jeez.
After everytin Feb15 d guy go don broke finish. From that 400k wetin remain fit bi like 20,000. The next tin na to dey borrow money from bank. No forget say na guys all over naija dey suffer this kain tin. So banks go dey borrow boys money the tin go dey wreck our GDP and the GDP na d major part of the economy. Why this tins dey happen like this. Na becos of valentine oooo!!

No comments:

Post a Comment